Papa oh
You no dey fade o
Your name n'ko o
E no dey sour
For every tongue
Na Your name be the sweetest
For every language
Na your name dey reign
Daddy oh
Your ears na wa o
Every language na im You dey hear
Hausa dey call You Ubangidi
Yoruba dey call You Olorun
Igbo dey call You Chineke
Excellent, Wonderful, Marvelous, Glorious
Alpha and Omega
Na im be Your name
Elshaddai, Adonai, Elohim, Rapha
Alpha and Omega
Na im be Your name
Papa oh
Na Your power dey fear me
You get power wey fit make life better
If You open am
Nobody fit to lock am o
If You lock am
Nobody fit to open am
Daddy o
Na Your love dey shak me
Your mercy n'ko na elele
I dey wait for the day
Wey i go be like You
Ooh, i no lie o
Papa na You be the best
Excellent, Wonderful, Marvelous, Glorious
Alpha and Omega
Na im be Your name
Elshaddai, Adonai, Elohim, Rapha
Alpha and Omega
Na im be Your name
Excellent, Wonderful, Marvelous, Glorious
Alpha and Omega
Na im be Your name
Elshaddai, Adonai, Elohim, Rapha
Alpha and Omega
Na im be Your name
(Your eyes dey run to and fro o)
24hours You slumber
(Baba O'kin sun rara o)
Even sef You no dey sleep
...